'Dis Nigeria sef' by Ken Saro Wiwa

'Dis Nigeria sef' by Ken Saro Wiwa





Oder people dey speak one language

Your own come pass two hundred:

Sanu, ekaro, deeyira, tank you, doo

kakifo, nonsense, you no go fit take one!

Nigeria, you too like borrow borrow

You borrow money, cloth you dey borrow

You borrow motor, you borrow aeroplane

You borrow chop, you borrow drink

Sotey you borrow anoder man language

Begin confuse am with your confusion

Anytin you borrow you go confuse am to nonsense

Idiot debtor, wetin you go do

When de owners go come take dem tings?

Post a Comment

0 Comments